Minister of Defence Bashir Salihi Magashi don tell the men of Special Weapons and Tactics Team SWAT say make dem dey always dey follow the rule of democracy and principles of human right. Wen Magashi dey yarn as he go visit the training camp of the officers for Nasarrawa state, he come talk say need dey to collobi modern policing even as dem dey carry out their duties. The minister come still talk say President Muhammadu Buhari dey ever ready to fully reform the police.
We go promote our men wen kpuff- IGP Mohammed Adamu
The Inspector-General of Police, Mohammed Adamu, don talk say dem go promote the kpokpo dem wen kpuff during the #EndSARS protests across the country go their next rank. Na on Wednesday nai Mr. Adamu for take yarn dis one for Benin City, Edo State wen he dey address police officers for the state police command wen he go visit dem to increase their morale. The IGP come talk say dem go compensate the families of those wen lose their lives and those wen injure as a result of the #EndSARS violence.
Naija nai import tokunbo cars pass for Africa-UNEP
One new report don show say na Naija nai be the African country wen dey import tokunbo motor pass from the United States, and the third for the world. The report wen the United Nations Environment Programme (UNEP) drop say Naija rank dey just below the United Arab Emirates (UAE) and Mexico. According to UNEP, na 14 million light-duty vehicles (cars, SUVs and minibuses) nai dem export go low and middle-income countries between 2015 and 2018.
2023 Elections: INEC go start voters registration next year
The Independent National Electoral Commission INEC go start registration of people wen dey qualified to vote by 2021 ahead of the 2023 general elections. Na chairmo of the commission, Mahmood Yakubu nai yarn dis one for one interview wen he get with news people on Wednesday, just after him 2021 budget defence for the Senate. Yakubu come talk say the exercise wen go start for the month of January go run for the next 18 months and den e go stop about six months before the elections. He come las las talk say dem don budget N1 billion for the registration exercise.
Delta State: Nursery school go resume on Monday
Delta Governor Dr. Ifeanyi Okowa don approve the reopening of public and private nursery schools for the state for the starting of the 2020/2021 academic session beginning from on Monday, November 9, 2020. Wen the State Commissioner for Basic and Secondary Education, Mr. Patrick Ukah dey yarn for one statement for Asaba today, he come talk say dem review the resumption from the scheduled date of January 2021 because of say the Covid-19 okamuka don dey reduce and also becos of the advice from the state Ministry of Health. Ukah come warn school heads for the state say make dem take extra and make dem really observe the Covid-19 protocols becos na small small pikins nai dey for nursery schools.
Yawa gas as Police man sue tailor
The Divisional Police Officer wen dey in charge of Iyaganku division, Ibadan, Alex Gwazarzah don carry one fashion designer Lukman Adeniyi go court becos he carry him cloths give person wen dry learn work for the shop make he sew. Gbege come burst out after the DPO claim say the tailor damage the cloths. The Police Public Relations Officer, Oyo State Command, Olugbenga Fadeyi, come talk say agreement dey say na the tailor nai go sew the cloths by himself, but he come carry dem go give another person, meanwhile the Commissioner of Police don involve for the matter and he dey soji the case.
FG dey beg ASUU to resume work
The federal government don beg the Academic Staff Union of Universities (ASUU) again say make dem return to work. The Minister of state for Education Emeka Nwajiuba wen beg the beg during one interview for Abuja come talk say the way wen things dey now for the country don really affect the capacity of government to fully address the demands of ASUU. The federal government dey seek the approval of the national assembly for one $1.2 billion agricultural financing loan. Na Zainab Ahmed, the minister of finance, budget and national planning nai make the request on Tuesday when she appear before the house committee on finance even as she dey defend the ministry budget, she come talk say na from the Brazilian government nai dem go for take collect dis loan. Meanwhile Naija total public debt stock, wen dey made up of the three arms of government, stand for N31.009 trillion by the end of June 2020.
Delta State government don adjust curfew to 10pm
The Delta State government don adjust the curfew time for the state. This one show for one statement wen the Secretary to the state government, Chiedu Ebie sign. According to the statement, the new curfew time na 10:00pm to 6:00am and e dey start from Wednesday 4th November 2020. The statement also commend deltans as Dem dey corporate with government for peace to reign.
Naija give US Army permission- Magashi
The Minister of Defence, Bashir Magashi don talk say the United States Army get Naija permission to rescue their citizen for northern Naija. Magashi clear news people dis aproko for the National Assembly on Tuesday just after the ministry budget defence. Meanwhile, dis comment dey come up three days after the Naval Special Warfare group for the United States wen dem dey popularly dey call SEAL Team Six, rescue Philip Walton, one 27-year old U.S. citizen wen bad guys hold hostage for Naija.
SARS throw me from two-storey- Lagos Trader
One trader Ndukwe Ekwekwe don narrate how he take end up for wheelchair after SARS the police wen Federal government don dissolve fling am come down from one two-storey building on February 16, 2018 for Lagos. Ekwekwe wen him mama escort go the Hearing of the Lagos State Panel of Judicial Inquiry come clear the panel say he dey deal on phone accessories and other items and say na three shops nia he get for Alaba market. The trader wen yarn for Pidgin English come talk say casala come burst out when four SARS men wen carry better fash show up around 2pm on February 16, 2018 for him shop for Alaba and na so dem come start to dey handcuff him without any explanation. Ekwekwe come talk say when he ask dem d crime wen him commit, the officers come talk say dem dey act on the order of the Inspector-General of Police, Mohammed Adamu.