American songstress, Rihanna rotate enter her verified Instagram account to inform her 87.6 million followers say her heart don scatter for Naija. The singer don join other international celebrities like Diddy, Trey Songz, Big Sean, and others add their voices to the ongoing #EndSARS protest for the country. For her message, the multiple award-winning Grammy artiste say she dey proud of the youths den he come tell the protesters say make dem no give up on the fight.
NNPC: We loss N20.2 billion for 2019
Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) don talk say dem record loss of N20.2 billion for 2019. Dem yarn this one for their latest audited annual financial statement. Details of the statement of account for the year wen end on December 31, 2019 show better loss of more than N16.3 billion by the corporation and N20.2 billion by the group. For 2018, the corporation record more than N203.2 billion for losses while the group lost about N68.95 billion
Naija people for South Africa dey join #EndSARS protest
Hundreds of Nigerians wen dey base for South Africa don talk say them go join the #EndSARS protests to show say dem dey with Nigerian youths when dey demand an end to police brutality and good governance among others. Them drop d aproko for inside one statement wen the Presido of the Nigeria Union South Africa (NUSA), Mr. Adetola Olubajo sign on Monday for Lagos. Nigerians wen dey for South Africa go gather on Wednesday, Oct. 21, 2020, for the Peaceful Protest March go the High Commission of the Federal Republic of Nigeria for Pretoria.
We go tidy the demands of Naija youths-NGF
The Nigeria Governors Forum (NGF) don talk say dem go tidy the demands of Nigerian youths wen dey protest against police brutality and harassment for across the country. Na for the past two weeks nia thousands of youths don dey for the streets dey ask for end to police brutality and d quenching of d Special Anti-Robbery Squad (SARS) of the Nigerian police and serious reforms. For one statement wen the chairmo of the NGF, Governor Kayode Fayemi of Ekiti State sign on Monday, the NGF say “governors don endorse the demands by demonstrators for improved governance”. Dem say dem don still agree to set up one Judicial Panel of Enquiry to receive all cases of police brutality by officers of the disbanded SARS Unit. “Each State still dey expected to start one compensation system for all victims
Government don arrange to pay compensation for people wen police kpuff
Governor Ifeanyi Okowa don talk say the state government go arrange one Special Victims’ Support Fund for the payment of compensation in the form of money give deserving people wen police don maltreat and those wen our olokpa dem don kpuff for the state. Na yesterday nai the governor take make the announcement for Asaba when he dey inaugurate one eight-member Judicial Panel of Enquiry wen go soji police brutality and other human rights abuses for the state. Okowa come talk say e dey very sad say those wen get d power to protect the lives of Nigerians nai come dey kpeff and dey brutalise them, he come tell the panel to dig out all human rights abuses wen Special Anti-Robbery Squad (SARS) operatives wen dem don dissolve carry out and den deliver justice to the victims and assistance to d families wen dey mourn.
#EndSARS protesters raise funds for crippled people
The #EndSARS protesters don raise more than N4 million in less than 24 hours for two physically-challenged protesters when join the protest dis past weekend. Na so people upload one of the protesters wen her name na Jane den dem come call her hero unto say she no allow her condition stop her from joining the protest. Na one popular medical doctor for Twitter, Chinonso Egemba, wen dem dey call Aproko doctor nia start the fundraising for her after he talk say she need to get artificial leg so dat she go fit dey waka well. Meanwhile, another protester wen dem identify as Charles Nnaman, wen get the same challenge as Jane go still benefit from the donation.
SWAT training go start today-NPF
The police authorities don partner wit the International Committee of the Red Cross and other development partners concerning the training of the new Special Weapons and Tactics Team wen dey start today Monday. Na about 1,850 members of SWAT nai dey expected to take part for the three -week training wen dey hold for the Police Mobile Force Training School, Ila Oragun, Osun State and the PMF Training School, Ende Hills, Nasarawa State. Wen the Force otota, DCP Frank Mba dey yarn for one statement on Sunday, he come talk day the SWAT, when replace the Special Anti-Robbery Squad wen dem dissolve last week becos of their yeye behavior go receive training for humanitarian laws, police conduct for situation of gbege, human rights- especially for the use of force and weapons, arrest and detention, plus including others. The Inspector General of Police, IGP M.A Adamu, come talk say the new Police Tactical Team, SWAT go operate within very high professional and ethical standards, rule of law and dictates of best international policing practices.
NECO don postpone computer studies practical
The National Examinations Council NECO don announce the rescheduling of the Paper I Computer Studies Practical wen suppose hold today (Monday) between 10am and 1pm. Them come shift the paper go on Monday, November 16, 2020, between 10am and 1pm. For one statement wen the Head, Information and Public Relations Division, NECO, Azeez Sani drop on Sunday wen he title: ‘Rescheduling of Paper I Computer Studies Practical in the ongoing 2020 SSCE’, he come talk say them take the decision becos of the #EndSARS protests wen block the free movement for the city entrance gate for Benin.
Edo state government don dash dem 24-hour curfew
The Edo State Government don put 24-hour curfew for across the state until further notice. The curfew dey start from 4 pm today October 19, 2020. The government say dem decide to take d decision because of the jagudaism wen dey play for the state and the attacks on private individuals and institutions by ole ole dem wen dey form say dem be #ENDSARS protesters.
Naija Government don promise to pay ASUU N30bn for November
Naija government don promise say dem go pay ASUU N30bn before or on the 6th of November 2020. This one na part of their allowance wen dem work for,Oyibo say na Earned Academic Allowance (EAA). This one na wetin come out of the yarnings wen ASUU get with government. For the meeting on Thursday, Dr. Chris Ngige wen be the Minister of Labour and Employment talk say dem go pay N30 billion before or on the 6th of November while the remaining N10 billion, dem go spread am equal equal pay for May 2021 and February 2022.