President Muhammadu Buhari don talk say he no go gree make anybody use government money for campaign. According to Garba Shehu, presidential spokesman, oga presido make the statement wen dem dey close the federal executive council (FEC) for Abuja. Oga Buhari come tell cabinet ministers say make dem take advantage of technology take reach out to voters on the need for why the All Progressives Congress (APC) need to return for next month general election.
Chelsea wan buy higuain
Chelsea don senior up for their efforts to bring Gonzalo Higuain to the club for the remaining part of the season. Maurizio Sarri dey urge for strikers and him search come increase d more after Tottenham wire Chelsea 1 kondo for d Carabao Cup semi-final game wen dem play yesterday night. He don manage the Argentine striker Higuain before for Napoli and if dem meet again everything go go well but for now dem neva agree on any deal yet.
Military don release Abubakar
Our military don release Uthman Abubakar, north-east regional editor of Daily Trust Newspaper. Na Mannir Dan-Ali, editor-in-chief of the newspaper nia announce the release after he receive Abubakar wen one army officer carry enter the Maiduguri office. On Sunday, soldiers ball enter the head office of the newspaper for Abuja and their regional offices for Maiduguri, Borno state capital, and Lagos.
We Must Arrest You
The Police authorities don promise say dem no go lai lai comot from Senator Dino Melaye bonk until them arrest am. The Police come send more than 50 additional policemen join d ones wen dey before go Melaye caban wen dey for number 11, Sangha Street, Off Mississippi, Maitama, FCT. Meanwhile, tori dey play say d olokpa dem go fit use by force take arrest the lawmaker wen neva gree comot from him house since last Friday.
I Neva Dump APC
Imo State governor Rochas Okorocha don talk say d news wen dey play say he don dump he All Progressives Congress (APC) den forward march enter the Action Alliance (AA) no be true. Wen the governor dey yarn yesterday, he come talk say na those people wen get stolen tickets nia dey behind the blackmail. He come talk say he still tanda for d APC and say he go continue to work for President Muhammadu Buhari re-election and the victory of other APC candidates wen their way pure.
Another Win Again
Manchester United continue their winning ways for the premiership under their new manago wen be Ole Gunna Solksjear unto say dem hammer Newcastle United 2 kondo for the English premier league game wen dem play yesterday for St. James park. Na Romelu Lukaku nia down the first goal for 64 minutes of the game before Rashford come drop the other for 80 minutes. For the other side Chelsea 0-0 ogbolo with Southampton
Make Deltans Unite
Chairmo for Delta State Inter Party Advisory Council of Nigeria (IPAC), Mr. Fred Obi don tell Deltans say make dem begin to dey see themselves as one and say make dem begin to think of those things wen go make peace and unity dey among themselves say becos if dem work against each other, e go divide them. Obi when give the advise wen he dey voice wit news people for Asaba, come tell Deltans say make dem change their ways and say make dem desire to make progress for d year 2019. Even as the state dey prepare to elect new leaders between February and March wen go handle the affairs of the state, Obi come warn Deltans say make dem dey always dey put the interest of the state first before wetin dem go gain. He come say make all Political Parties and their Candidates dey criticize well about the policies of those wen dey for Government and say make dem suggest solutions without partia instead of dem to dey spoil their image becos e no make sense at all….
Campaign Flag Off For Sapele
Governor Ifeanyi Okowa go flag off him campaign for second term for Oghara and Sapele wen be d headquarters of Ethiope West and Sapele Local Government Area of Delta State by on Friday. Na Chief Paulinus Akpeki wen be d Chief Strategist of the State and the Chairmo for the Sapele PDP Campaign Committee nia drop dis tatafo wen he dey voice wit news people for Sapele. According to am, the Governor go dey for Oghara on the 4th of January, while on the 5th he go come ball enter Sapele with the State Chairmo of the party, Olorogun Kingsley Esiso and other State leaders of the party wen go mark present too.
Itsekiri People Dey Relevant
With the 2019 general elections wen be like six weeks away, Presido for d National Association of Itsekiri Graduates (NAIG) Collins Edema don tell itsekiris and youths in general say make dem get am for their mind say na dis election nia go determine the economic wellbeing of everybody. For Edema New Year message, he say the Itsekiri Nation no be political cross and say dem no go fit afford to vote for candidates wen go drag the kingdom, state and nation backwards, den he come talk say make dem cast their votes wisely make regret for no dey las las. According to am, the 2019 general elections na choice between immediate financial gains and sustainable development.
I Nor Go Surrender
Dino Melaye, the senator wen dey represent Kogi West don yarn from where he pem put, he come give d reasons why he no go lai lai surrender himself give the Nigeria Police Force. Mr. Melaye wen be talk before now say the Inspector-General of Police, Ibrahim Idris go shook am injection die if dem arrest am come talk say him challenges be like that of Prophet Elijah for the Bible and all dis one so dey for one tweet wen he drop yesterday evening. He come still talk say he go continue to hide for d ikoro wen he dey. U go remember say our olokpa dem surround the senator caban for Abuja on Friday becos according to dem the senator, and him jaguda dem shoot one Danjuma Saliu wen be sergeant for the month of July 2018.