The Senior Special Assistant to the President on top Media and Publicity, Garba Shehu, don explain how the Muhammadu Buhari administration take use d $322m wen dem recover from late Gen. Sani Abacha family. Wen Shehu dey yarn for Abuja, he come talk say dem use the dough take make the Conditional Cash Transfer of monthly amount of N5,000 to more than 300,000 poor homes for across the nation under the Social Investment Programme wen the Federal Government introduce. He come talk say the spending so dey in line with the Memorandum of Understanding wen the governments of Nigeria and Switzerland sign as condition wen dem take release the kpogri.
APC vs PDP
The All Progressives Congress (APC) don talk say Alhaji Atiku Abubakar, d presidential candidate of the Peoples Democratic Party (PDP), dey show “early signs of depression. Na Lanre Issa-Onilu wen be talk talk person for d APC nia yarn dis one wen he dey respond to wetin one of the aides of Atiku talk. Wen Phrank Shaibu, special assistant to the PDP presidential candidate dey voice wit news people, he come talk security agencies need to probe d link between President Muhammadu Buhari and Etisalat Nigeria. But Issa-Onilu don tell Atiku to tell Nigerians why he wan really be president instead “of am to dey raise any how any how allegations every day by day.
Ebola Patient Don Escape
Democratic Republic of Congo health ministry say 24 Ebola patients don shalay comot from one Ebola treatment center where dem for take dey receive treatment for Beni yesterday. The patients gats borrow leg after people wen dey protest the cancellation of on Sunday presidential election for the eastern city attack d place. D ministry spokeswoman Jessica Ilunga come clear news people say 17 of the patients don already test negative for Ebola, while dem neva test seven at all.
Serie A inside Pepper Soup
E clear say dem go fit suspend Serie A after one Inter Milan supporter denkwes after he rack with Napoli fans and na so dem stab four people for on top dis same matter. According to reports for Italy, dem rush the 35-year-old Inter fan go hospital after one motor wen Napoli fans dey drive knack am, one hour before kick-off for the San Siro on Wednesday. He come undergo sharp sharp emergency surgery but las las, he come legoo becos of d injuries wenhe sustain.
Military Palava
The Nigerian Army don admit say many police officers gbes without official permission from one counter-insurgency training facility for Yobe State. This one no be d same tin wit wetin d police first talk as dem take deny say no officers run wit weapons as dem take report am on Wednesday afternoon. The army say dem gbab some of the officers for Damaturu, the capital of Yobe State about 60 kilometres away from the training centre for Buni Yadi.
Gov Okowa Don Sign 2019 Bill
Delta State Governor, Dr. Ifeanyi Okowa don sign the 2019 Appropriation Bill of 390.3 billion naira enter law. The governor wen sign the bill yesterday for Asaba come talk say early signing of the bill into law go give him administration enof time to use the dry season take tidy construction works. Meanwhile, the 2019 Budget dey made of capital expenditure of 233.2 billion naira and recurrent expenditure of 157.1 billion naira.
2019: Money Palava
Zainab Ahmed, d minister on top finance, don talk say owners of expensive boats and private jets go begin dey pay for luxury items that is big items as from 2019. Wen d minister dey yarn for Abuja, he come talk say dem go introduce charges for some areas while dem go come reduce taxes for small and medium enterprises. According to Ahmed, the Whistleblower Unit don recover more than N8.5 billion and $465 million among others from the 1,051 investigations wen dem fire down wit from d tips wen dem receive.
PDP Blast Presido
Buba Galadima, one spokesman for the Peoples Democratic Party (PDP) presidential campaign organisation don talk say Muhammadu Buhari no go be Naija presido come May 29. Na wen Galadima dey voice for one Television programme yesterday nia he for take talk dis one. The PDP campaign spokesman come talk say since Buhari don leave the signing of the electoral act amendment to new government, he say Atiku Abubakar, wen be PDP presidential candidate, go sign d bill for d year 2019.
Police Tear Race
Nothing less than 167 police officers nia gbes comot from one training ground after dem hear say dem dey receive training so dat dem go go gbege Boko Haram badoo dem. The officers wen borrow leg so wen d force don declare wanted dey amongst the 2,000 additional police officers wen d Inspector-General of police Ibrahim Idris recently draft to support the efforts of the military against d boko haram jaguda dem for d North-east. The officers no gree submit their arms, ammunition and other official equipment wen dey wit dem when them dey tule. The force been send dem go for one induction training for the Nigerian Army Special Forces Training School for Buni Yadi, Yobe State. But many of them come start to dey fly after dem find out say na Boko Haram fighters wen no get conscience nia dem go go kira wit.
BMO vs PDP
The Buhari Media Organisation (BMO) don tell the People’s Democratic Party (PDP) and their Presidential campaign spokesperson, Buba Galadima say make dem get clear understanding of the laws wen dey guide campaign funding before dem make public statement on top d contribution wen people make to the campaign of President Muhammadu Buhari. The Organization blast Galadima becos according to dem, he dey ignorant and say na frustration nia dey worry am becos Nigerian farmers donate about N1.2 billion for oga Buhari campaign. For one statement wen Niyi Akinsiju and Cassidy Madueke, Chairmo and Seceto sign, d BMO say Galadima no know about d laws wen dey guide the Electoral Act.