The House of Representatives don blast the Federal Government as dem take give schools the go-ahead to resume today Monday undermining say cases of COVID-19 dey increase. The House on Sunday say government officials no consult the relevant committees of the National Assembly, and say dis one dey against wetin dem talk say dem reason wit all relevant stakeholders before dem conclude to resume school on January 18, 2021. Dem come say make d federal government postpone d resumption of schools for three months, if d schools no put d necessary safety measures in place and if their compliance with d covid protocols dey low.
No put mouth for NDDC matter- Edwin Clark
Edwin Clark, chairmo of Pan-Niger Delta Forum (PANDEF), don tell Godswill Akpabio say make he to stop shook mouth put for the affairs of the Niger Delta Development Commission (NDDC). Akpabio nia be the minister of Niger Delta affairs. Wen Clark dey voice when he receive Effiong Okon, NDDC interim administrator for him caban for Abuja on Wednesday, he come say dey complain say he no like d way wen d minister take dey steadily dey shook eye put for d NDDC. The PANDEF chairmo come tell the federal government to fund the East-West road when begin under before before Presido Olusegun Obasanjo.
Okowa performance go give PDP victory- Olisa Ifeajika
The Chief Press Seceto to Delta state Gov. Dr. Ifeanyi Okowa, Mr Olisa Ifeajika don talk say the governor make sense performance for the 25 local government areas of the state go give the Peoples Democratic Party (PDP) victory in the March 6 local government elections for the state. Ifeajika yarn this one during one television interview for Asaba, the state capital He come talk say PDP, under the administration of Okowa get landmark projects across the state to showcase before Delta State Independent Electoral Commission (DSIEC) go remove d ban wen dem place on campaigns.
Dem no get level- FG
The presidency don talk say d “ultimatum” wen the Muslim Solidary Forum give Matthew Kukah, bishop of Sokoto Catholic diocese, say make he apologise or leave the state becos of wetin he yarn about Muslims no get level. Wen Kukah dey preach for him Christmas message, he come accuse President Muhammadu Buhari say he dey favor some people pass some people. The bishop statement come make different Muslim groups dey parasid, den on Wednesday, the Muslim Solidarity Forum come tell Kukah to apologise or make he vamuss comot from sokoto state becos according to dem, he attack Islam.
COVID-19: Naija confam 1,398 new cases
Naija curve of coronavirus infections continue to dey go up unto say on Wednesday, dem confirm 1,398 new cases for across the country. The Nigeria Centre for Disease Control NCDC say dem record more than 1,000 for across the country for the tenth day back to back, more than 9,000 fresh infections within the past seven days. With the new infections wen dem confirm for 22 states and the federal capital territory (FCT) for January 13, 2020, the country count of active cases for now don pass 20,000.
We wan grow economy wen no depend on oil-Aniagwu
Delta state Government on Tuesday talk say the Agro-Industrial Park wen dem dey arrange for Aboh-Ogwashi for Aniocha South Local Government Area go help to bring economic transformation for the state. Na d Commissioner for Information for the state, Mr. Charles Aniagwu nia yarn this one during wen he dey soji d project, he come talk say d Gov. Ifeanyi Okowa administration dey committed to grow a Delta economy wen no dey depend on oil. According to Aniagwu, he come still talk say this one na the time to remove eye comot from oil and say dem go do as dem don talk.
Man U kpokpo Burnley 1-0
Na Paul Pogba nia down d winning goal as Manchester United move go top of the Premier League as dem kpokpo Burnley 1 kondo. United need only one point on Tuesday to go on top champions Liverpool ahead of the two teams’ serious clash wen go happen for Anfield this weekend. But Pogba wen dey always finish work come convert Marcus Rashford cross with 19 minutes wen remain for d game to end to make sure say United move three points clear of their great rivals.
Develop plan wen go help school for this Koro period-SSANU
The Senior Staff Association of Nigeria Universities don tell the federal government and academic unions to come up with system wen go allow the education sector function even wit the covid-19 okamuka wen still dey. National Vice Chairmo of the body Abdussobor Salaam wen yarn on Tuesday for Lagos come dey complain about the way d matter don take dey affect the Nigerian youths.
Naija loss N5.4 trillion between 2007 and 2017-FIRS
The Federal Inland Revenue Service (FIRS) say the country lost N5.4 trillion becos of multinationals wen no gree pay their tax. Wen Muhammad Nami, the FIRS chairmo dey yarn for one workshop for Abuja on Monday, he come talk day dem lost dis pepper between 2007 and 2017. Nami come talk say to solve this problem, the FIRS don create 35 additional tax audit units for across the country to address all d mago.mago wen dey on top d matter.
Covid-19 Vaccine: We dey work on the type to buy-Zainab Ahmed
Zainab Ahmed, the Minister on top Finance, Budget and National Planning don talk say the federal government dey work on the type and quantity of COVID-19 vaccines wen dem go buy. Wen d minister dey yarn on Tuesday for the online public presentation of the 2021 budget, she come talk say the finance and health ministries go run mind together and den finalize a particular amount wen dem go use take buy d vaccine within the next two weeks. The finance minister come still talk say d lawmakers dey committed to provide supplementary budget for additional spending on COVID-19 vaccines if need be.