Need don dey for top top people for the state to praise the big steps wen Governor Ifeanyi Okowa don take to bring peace and unity wey dey attract beta things come the state. The speaker of the Delta State House of Assembly, wen be Hon. Sheriff Oborevwori, naim yarn dis one wen Comrade Sheriff Mulade carry officials of the Ijaw and Itsekiri, peace and unity cup football tournament come him house for Asaba wen be the state capital. The Speaker say wetin Okowa don achieve go lead to big tinz for the state. He con call on everybody, say make dem do tinz wen go promote peace and unity for their different communities.
El- Classico match fit move from Camp Nou to Bernabeu
The El- Classico match wey Barcelona and Real Madrid suppose play on October 26 tori dey come say them fit move am from Camp Nou to the Bernabeu, wen be Real Madrid home. This matta dey come onto say the people wen dey organize the Spanish league dey fear say kasala fit happen for Camp Nou. People wey dey catalonia dey protest say dem want their independence and Camp Nou na the catalonia e dey.
Army don change python dance to dance of peace
The Nigerian Army don say them don changed the name of one of their exercise wen dey go on for the south-east region of the country from Python Dance to Atilogwu Udo. The Nigerian Army Operations Media Coordinator, wen be Col Aminu Iliyasu, yarn the matta for one press release, he say the new name nor go affect the other tins wen them dey tackle like kidnappings, armed robbery, inter-cult and community gbege for the region. Meanwhile them come say make area nor let fear catch them becos the meaning of Atilogwu Udo for Igbo language na dance of peace.
Fire for Onitsha burn 40 buildings,kill woman and pikin join
Tori don show face say one woman and her pikin kpuff plus 40 tall buildings nai destroy for fire wey happen for Upper Iweka, Onitsha for inside Anambra state. Over 500 shops wey lock nai the fire still burn along the Iweka street market wen lead to Ochanja and Menax market. This okpetue happen wen one tanker wey carry fuel dey drive down from Zik’s roundabout wen be the end of Onitsha – Enugu expressway, loss control around Toronto Hospital con divert commot from the service lane. The tanker head fall commot from the body, na so the fire take start to catch after the fuel pour for the area.
Make government officials work together for beta
Delta State Governor Dr. Ifeanyi Okowa don ginger top government officials say make dem work together so that them fit do beta thing for the people. The governor yarn dis mata wen he declare open one workshop for top government officials for Onicha-Ugbo, wen dey Aniocha North Local Government Area of the state. Meanwhile governor okowa come talk say him administration dey build structures wen go last the state. He say plenty tins still full ground wen them go do for the state.
Insecurity for Obodo Naija dey increase everyday
Adedayo Faduyile, wen be presido of the Nigeria Medical Association (NMA) don yarn say he dey vex because of the way wen insecurity level take dey increase for the country. Na on Tuesday, for inside one press conference, wen dem hold, to take mark the ‘2019 World Physicians week’ for Akure, Ondo state, niam he take yarn dis one. Im talk say e don pass 48 medical dockintors, wey jaguda people done kidnap, for the last two years. Faduyile come say, as whahala plenty reach for dockintors for the country, dem come still dey worry over matter like “kidnapping, quarrel and gbege, from patients and their family people.
Person wey go replace Francis Uzoho well dey NPFL
Before before Super Eagles goalkeeper coachee wen be Joe Erico, don yarn say person to replace Francis Uzoho wen woundjure, dey inside the Nigeria Professional Football League. The Nigeria Football Federation team doctor, wen be Ibrahim Gyaran, don confirm am say Uzoho go dey out for atleast six months after he twist him leg on Sunday, for the rob-body game wen dem play with Brazil. Dis one so go make am dey absent, for Nigeria first Africa Cup of Nations qualifying opening game against Benin Republic, wen go take place on November 11th for Benin.
FG Don Ready to Review Salaries and Allowances
Chris Ngige wen be Minister of Labour, don yarn say the federal government go review the salaries and allowances of political office holder for the naija. He yarn dis one wen delegates of the Nigerian Union of Local Government Employees (NULGE) visit am for him office, for Abuja. The Minister come say dem go look into the 12 wage structure for the country, plus the allowance of all political office holders.
ULC say strike wey labour plan na Capital Fail
The United Labour Congress (ULC) don describe the strike wey labour plan once d deadline wen dem give federal government to take pay the new minimum wage give every civil servant pass, as capital fail. For inside one statement, wen the ULC Presido, wen be Joe Ajaero, drop, he yarn say, ULC, nor go enter strike wen carry the real struggle of Nigerian workers. But for another side, the meeting wey labour, and the Federal Government dey hold over the minimum wage matter, go still continue today, to see whether dem go fit reach agreement. For the meeting, wen dem hold yesterday for Abuja, the Head of Service, wen be Mrs Folashade Yemi-Esan, yarn say, she get hope say, today meeting go bring beta result.
Ezenwa never play since the last Africa Cup of Nations
Gernot Rohr don explain the reason why him bring Maduka Okoye to come keep instead of Ikechukwu Ezenwa for the game wen them play with Brazil on Sunday. Rohr yarn say Ezenwa wen be number two for the picking order of goalkeeper never taste action since them finish the 2019 Africa Cup of Nation, meanwhile Okoye don dey active since.