One member for the House of Representatives, Yusuf Gagdi, don talk say the Department of State Services, DSS no send any report give the National Assembly concerning wetin d Minister of Communications and Digital Economy, Isa Pantami yarn, during him ministerial screening for d year 2019. Gagdi yarn that one on Monday during one interview for Abuja The lawmaker yarn dis one wen he dey react to d claim wen one before before Assistant Director with the DSS, Dennis Amachree make say the secret police screen Pantami before dem confirm am as minister for d year 2019 but say the minister pass through National Assembly screening becos of many factors including federal character balancing.
Soldiers kpeff as jet bomb dem for Borno
Some soldiers don denkwes after one fighter jet wen belong to the Nigerian Air Force fire bomb on ground troops for Mainok, Borno state. Military sources clear news people say d air force mistakenly hit the wrong coordinates while dem dey target Boko Haram badoo dem wen been don attack the soldiers on Sunday. Wen Edward Gabkwet, air force otota come dey yarn on Monday, he come talk say dem dey soji d matter.
Security matter for naija dey disturb mind-APC
Naija ruling party, the All Progressives Congress (APC), don agree say the current security situation for across the country dey worry mind. The party come talk say while their government wen President Muhammadu Buhari dey lead don achieve a lot for infrastructural development for across the country, dem say na only wen everywhere dey safe nia we go fit take enjoy the current infrastructure. The APC for inside one statement wen their interim National Seceto, John Akpanudoedehe drop come talk say dem no go Lai lai play politics with the security situation.
Bad guys kill one pesin,kidnap 4 for Kaduna church
The Kaduna State Government say na one person nia denkwes wen bad guys attack Haske Baptist Church for Manini village for Chikun Local Government Area of d state. The News Agency of Nigeria (NAN) say the gunmen attack the church at about 9.a.m on Sunday. The government say na one Zechariah Dogonyaro nia dem shoot die den Shehu Haruna come wunjor. Then wen the police command for the state come dey yarn on top d matter, dem come say apart from those wen kpeff and injure, the bad guys kidnap four worshippers.
Okowa send condolence to itsekiri nation as Olu of Warri don kpeff
Governor Ifeanyi Okowa on Thursday salute the Itsekiri people for the state becos of their king Ogiame Ikenwoli, the Olu of Warri wen don denkwes. Okowa clear members of Olu of Warri Advisory Council, when visit am for d Government House, Asaba, say the Olu wen don kawasaki so na man wen like peace and say he make sure say war no dey for across the different tribes for the country. He say the late olu contribute well well to the peace and development of not only Warri Kingdom, but the state and the country. The governor come congratulate the Olu-designate, Prince Tsola Emiko, den he come tell d Itsekiri people to give am their full support..
Buhari approve money for FRSC
President Muhammadu Buhari don approve intervention funds for the renewal of the Federal Road Safety Corps (FRSC) fleets and formations wen kwango during the 2020 #EndSARS protests for across the country. Na the Seceto to the Government of the Federation, (SGF), Boss Mustapha nia voice dis one wen dem go inspect the operational motor dem and tow trucks wen dem recently buy for the FRSC on Thursday for Abuja. He come talk say dem dey do dis one so dat dem go fit enforce road traffic regulations well and to also rebuild the buildings wen burn.
House of Reps go torchlight trade of human parts
The House of Representatives don decide say dem go torchlight d news wen dey play say illegal trade of human private parts dey go on between Naija and China. The house take dis decision after all of dem agree on d motion wen Rimamnde Kwewum (PDP-Taraba) sponsor den Olajide Olatubosun (APC-Oyo) come support am for their on Thursday meeting. Wen Mr Kwewum first dey move d motion, he say about two weeks ago, Chinese authorities seize one cargo ship wen move from Naija with 7,200 gbolas wen don cold for fridge.’ He come say the Chinese General Administration of Customs come raise alarm say some large number of armed groups for Africa dey use d human parts wen dem collect for very bad conditions take dey tidy their yeye paroles.
We don upgrade security for Naija borders
Bashir Magashi wen be d Minister on top defence don talk say them don make security for the borders more cajad so dat plenty Chadian refugees no go dey pack enter Naija. Magashi wen yarn this one on Thursday during one state house briefing come talk say dem decide to make the move becos of d things wen dey happen of recent for Chad. The matter na say Mahamat, d son of the late Presido Idriss Deby, take over as leader of Chad after him peele legoo on Tuesday.
Nigeria Union of pensioners go protest on Friday
Members of the Nigeria Union of Pensioners don talk say dem go fire down wit one serious nationwide protest on Friday becos d government don fail to increase their pension. Na Outgoing Presido of the NUP, Abel Afolayan, nia yarn dis one for Abuja for the 11th quadrennial delegate conference of the union on Wednesday. He come talk say him members go block the Office of the Seceto to the Government of the Federation during the protest.
Amazon don choose south Africa as their African Headquarter base
Amazon, one United States multinational technology company, don choose South Africa as the headquarters for their African market. This matter so dey come up one week after Twitter, US-based microblogging and social networking service announce the opening of their first-ever African office for Ghana. Meanwhile, the announcement so don make Nigerians dey talk plenty for social media.