President Nana Akufo-Addo don win the 2020 presidential election for Ghana unto say he beat im closest challenger and before before presido John Mahama wit 6,730,413 votes wen be 51.59 per cent of d total votes. Mr. Mahama, when contest under the platform of the National Democratic Congress, get 6,240,889 votes wen be 47.36 per cent of the votes. Mr. Akufo-Addo, when contest for the platform of the New Patriotic Party, win for seven of the 16 regions while Mr. Mahama win for nine.
President no gree show face for House of Reps.
President Muhammadu Buhari no gree mark present before the House of Representatives today. You go remember say oga Buhari been talk say he go appear before the House today wen he dey respond to the invitation wen d house give am last week to address Nigerians on the growing insecurity for the country. The matter na say d house been summon the President after one long debate on the way wen boko haram badoo dem take slaughter more than 43 rice farmers for Borno State.
Slumping tinz: Maina collapse for court
The before before Chairmo of the Pension Reform Taskforce Team wen no dey function again, Abulrasheed Maina, when dey face money laundering charges collapse today before trial Justice Okon Abang for the Federal High Court for Abuja. Maina collapse just after the court resume proceedings for the 12-count charge wen the Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, take sama and him company Common Input Property and Investment Limited. On Wednesday, after the EFCC close their case with nine witnesses, Maina come get permission of the court to enter no-case-submission to the charges wen dey against am.
Riot burst as report say police kill keke driver becos of N100 for Port Harcourt
Riot happen today for d Rukpokwu area of Port Harcourt as one olokpa legoo one guy man wen dey ride keke. The matter wen happen around 7am for Airport road come cause better riot for the area unto say some youths wen dey provoke becos of d level come take over the major road as dem dey protest. The tok tok pesin for Rivers state Police, SP Nnamdi Omoni wey confam di tori say dem don arrest and disarm di kpokpo wen dey involved and im orderly room trial don already begin come add say dem go charge am go court within di next 48 hours. Meanwhile aproko wen dey reach us na say the kpokpo kpuff d keke rider becos he no gree give am N100 bribe.
Pishure: President Buhari don swear-in INEC Chairman for 2nd term
President Buhari don swear in Prof. Mahmood Yakubu as INEC chairmo for second term. This one na after the senate house confirm am for Abuja.
Naija embassy for Germany sack worker wen demand sex to renew passport
The Nigerian Embassy for Berlin, Germany, don fire Martins Adedeji Oni, one security officer, when report say dey demand for sex in return for help to renew people passport. The agency say Mr. Oni employment contract end wen dem start to dey torchlight am based on d allegations of corruption and sexual misconduct wen dey him head. “Mr Oni been first receive suspension from duty on 17 November after reports show say he dey gbalor people in return for help with the renewal of passport.” President Muhammadu Buhari (retd.), on Tuesday, say the caretaker extraordinary convention planning committee of the ruling All Progressives Congress wen Governor Mai Buni dey lead don succeed to bring new atmosphere of hope to the party. Buhari yarn dis one for him opening speech for the meeting of the party National Executive Committee wen hold for the Presidential Villa, Abuja. He come still tell the leaders to respect party decisions.
US blacklist Naija, Naija react
For the second time for inside one row, the United States don list Naija amongst Countries of Particular Concern (CPC) wen dey guilty of “serious violations of religious freedom.” News people report show how them take add Naija join the CPC after the United States Commission for International Religious Freedom (USCIRF) find dem guilty for d year 2019. The report say “religious sectarian violence increase during the year, with Muslims and Christians wen receive attack based on their religious and ethnic identity.” Meanwhile, The Nigerian government don talk say dem no go gree based on d way wen d united states take list the country amongst Countries of Particular Concern (CPC) wen dey guilty of “serious violations of religious freedom.” The U.S. at first add Naija join the CPC after the United States Commission for International Religious Freedom (USCIRF) find Naija guilty for 2019. Dem use the violation of rights of Shi’a members of the Islamic Movement in Nigeria (IMN), wen their leader Sheikh Ibrahim El Zaky Zaky still dey for prison as example undermining say one court order him release.
NPC don say 206 Million people nai dey Naija
The National Population Commission (NPC) don talk say we get estimated 206 million people wen dey long side for Naija. Na Nasir Kwarra, chairmo of the commission nia drop dis tatafo wen he dey yarn on Tuesday for one press conference even as dem dey start the 11th phase of the Enumeration Area Demarcation (EAD) for Abuja. Kwarra come talk say dem arrive at the figure based on projections, becos dem no go fit know d exact population without census.
NECO dey investigate schools wen do expo
The National Examinations Council (NECO) don arrange one administrative panel wen go investigate some Schools and people wen involve for expo for d Senior Secondary Certificate Examinations, (SSCE) wen dem just conclude. The examination body yarn dis one wen dem dey respond to one investigative report wen Signature Television release on December 2nd, 2020 wen show say malpractices take place for some examination centers for Kaduna. For one statement wen the Head Information and Public Relations Division of NECO, Azeez Sani drop for Minna on Monday, he come talk say dem go deal with those schools and d people wen involve.
Waffarians roast three Omila for Warri South
Hand touch some omila wen go rob for Okumagba lay-out for the Warri south local government area of Delta state dis early mor mor. The matter na say the guys wen reach six go rob but their goat come born nama wen hand touch three of them. While dem roast two of them for Emebirhen junction, dem come cramp the last one wen be dey try escape and na for Ojabugbe junction dem come take roast that one. This na wetin one of the eye witness get to talk on top d matter. He come later advise our youths make dem find something do so that all these kind yeye matters no go continue to dey sup.